Content pfp
Content
@
0 reply
0 recast
0 reaction

butu pfp
butu
@butu
Good morning oma people wey dey sharp how una dey this morning,I hope say body dey gidigbam like Michael power. Another ogbonge day don break bikonu, you know say person wey never die them no dey bury am, na em make me say make we go hustle today make we see wetin we go use dey charge our battery make we get full current. I dey pray say as we dey comot for house make wetin we go collect make em dey for road dey wait for us, if we turn for front we go see collect and we turn back we go see collect too na oma day em go be for us all, Amen. ✍️ @ettetor
1 reply
1 recast
2 reactions

Derek  pfp
Derek
@badadvicehq
Amen o correct man! 🙏
1 reply
0 recast
1 reaction