0 reply
0 recast
0 reaction
Eje, the way i take broke right now, if my girlfriend just talk say she wan leave me, omo, i dae follow her go o.
How man take dae survive now na God hand e dae, i just dae use sign of the cross take see front for road cause if i stop to pray, e don be for me.
See wetin man eyes don see, mouth no let am talk, if dem wan come carry my babe, abeg carry me join.
The painful thing be say, once people con dae advice you, dem go dae advice you like say your brain no dae function, like say u no get sense.
I just dae observe sha, everywhere good.
#pidgin 11 replies
9 recasts
19 reactions
0 reply
0 recast
0 reaction