monday ogah pfp
monday ogah
@investorawesum
Dear Phaverians. Many questions don dey on top TGE matter as July dey end. We don dey work hard onto TGE matters all year and we dey sure for our plan to release inside July but because of one thing one other we no come fit announce the date of listing till now. Nah unto say we dey work on a daily basis to try deliver before the date but e no come work out at all. As many don talk before, many Phaver users dem don dey use Phaver for more than 2 years. We for easily list for small exchange dem anytime, but we owe dem to list well and make sure say everything go well especially with the right partners. But as e dey so e dey take more time, our promise nah say unnah go happy say we take small extra time. Phaver nah long-term project wey 15% of total allocated User Rewards only nahim dey Season 1 and the main function for changing Points to Tokens go start for Season 2, so nah why e dey important to launch well for long term success no be for sharp sharp profits. 👇👇👇👇
0 reply
1 recast
8 reactions

monday ogah pfp
monday ogah
@investorawesum
The team no go benefit if the TGE no go well and no get any reason to delay the TGE, so we dey work day and night to make sure all Phaverians go dey happy at the end. We don learn from the last announcement, so we no go give another date again until we don sure say we don ready, but make unnah mind calm TGE go happen soon. As we wait the best way unnah fit help to make the launch succeed nah to talk good about Phaver and no join others to talk wetin no good wey go spoil things and put sand for everybody garri. As we continue to dey work hard, abeg keep Phavering and open your eyes for time to time updates for our official channels dem. You still fit join the Community Call this Thursday sha for 1 pm UTC to hear more Tori from Jagaban dem @Joonatan & @Tomi 📍https://phaver.huddle01.app/room/cny-htwr-bxd
0 reply
0 recast
0 reaction